Números 33
PCM vs NTLH
1 Dis na di place dem wey Israel pipol travel go, afta dem komot from Egypt akordin to dia tribe, just as Moses and Aaron kommand dem.
1 São estas as caminhadas dos israelitas que saíram do Egito, grupo por grupo, debaixo das ordens de Moisés e Arão.
2 Akordin to God kommand, Moses kon rite di names of each place wey dem stay.
2 Moisés ia anotando os nomes dos lugares de onde partiam, de acordo com as ordens de Deus, o Senhor . E são estas as caminhadas conforme os lugares de partida:
3 Israel pipol komot from Egypt for di fifteent day for di first mont wey bi di day afta di Passova. For Egypt pipol present, dem kon komot from Rameses town and God guide dem.
3 O povo de Israel saiu do Egito no dia quinze do primeiro mês do ano, um dia depois da primeira Páscoa . Eles saíram de Ramessés de maneira vitoriosa, e todos os egípcios os viram.
4 Naw, Egypt pipol beri all dia first-born pikin wey God kill and God still ponish dia juju.
4 Os egípcios estavam sepultando os seus primeiros filhos que o Senhor havia matado. Assim, o Senhor mostrou que era mais poderoso do que os deuses do Egito.
5 Israel pipol travel from Rameses go Sukkot.
5 Depois de saírem de Ramessés, os israelitas acamparam em Sucote.
6 From Sukkot, dem go Etam wey dey klose to di wildaness.
6 Saíram de Sucote e acamparam em Etã, que está na beira do deserto.
7 Dem travel from Etam go Pi Hahirot wey dey before Baal-Zefon and dem kon stay near Migdol.
7 Saíram de Etã e voltaram a Pi-Hairote, que fica a leste de Baal-Zefom, e acamparam perto de Migdol.
8 From Pi Hahirot dem travel pass di middle sea go di wildaness kon use three days travel go Etam Wildaness for Marah.
8 Saíram de Pi-Hairote e passaram pelo meio do mar Vermelho e chegaram ao deserto de Sur. Caminharam três dias no deserto e acamparam em Mara.
9 Dem travel from Marah go Elim; twelf wota fountain and seventy palm tree dey for Elim, so dem kon stay der.
9 Dali foram para Elim e acamparam ali. Em Elim havia doze fontes de água e setenta palmeiras.
10 Dem travel from Elim go stay near di Red Sea.
10 Saíram de Elim e acamparam perto do golfo de Suez.
11 Den from di Red Sea, dem travel go Zin Wildaness.
11 Partiram dali e acamparam no deserto de Sim.
12 From Zin Wildaness, dem go Dofkah.
12 Dali foram até Dofca, onde acamparam.
13 And from Dofkah, dem travel go Alush.
13 Partiram de Dofca e acamparam em Alus.
14 Dem komot from Alush kon travel go Refidim, where wota nor dey for di pipol to drink
14 Depois de Alus, acamparam em Refidim. Porém ali não havia água para o povo beber.
15 and from Refidim, dem kon go Sinai Wildaness.
15 — ausente —
16 Dem travel from Sinai Wildaness go stay Kibrot Hattaavah.
16 — ausente —
17 From Kibrot Hattaavah, dem kon go Hazerot and
17 — ausente —
18 from Hazerot, dem travel go stay Ritmah.
18 — ausente —
19 From Ritmah, dem travel go Rimon-Perez.
19 — ausente —
20 Dem travel from Rimon-Perez go Libnah.
20 — ausente —
21 From Libnah, dem kon travel go Rissah.
21 — ausente —
22 Dem travel from Rissah go Kehelatah.
22 — ausente —
23 Den dem kon travel from Kehelatah go Mount Shefa.
23 — ausente —
24 Dem travel from Mount Shefa go Haradah.
24 — ausente —
25 From Haradah, dem kon travel go Makhelot.
25 — ausente —
26 Dem travel from Makhelot go Tahat.
26 — ausente —
27 From Tahat, dem kon go Terah.
27 — ausente —
28 Dem travel from Terah go Mitcah.
28 — ausente —
29 And from Mitcah, dem travel go Hashmonah.
29 — ausente —
30 Dem travel from Hashmonah go Moserot
30 — ausente —
31 kon from Moserot go Bene Jaakan.
31 — ausente —
32 Dem travel from Bene Jaakan go Hor Haggidgad
32 — ausente —
33 kon travel from Hor Haggidgad go Jotbatah.
33 — ausente —
34 Dem travel from Jotbatah go Abrona.
34 — ausente —
35 From Abrona, dem kon go Ezion-Geber.
35 — ausente —
36 Dem travel from Ezion-Geber go Zin Wildaness, wey bi Kadesh.
36 — ausente —
37 Dem travel from Kadesh go Mount Hor wey dey near Edom.
37 — ausente —
38 Aaron di priest klimb Mount Hor akordin to God kommand and e die for der for di nomba forty years wey Israel pipol komot from Egypt land for di first day for di fift mont.
38 Por ordem de Deus, o Senhor , o sacerdote Arão subiu o monte Hor. E morreu ali, no dia primeiro do quinto mês, quarenta anos depois que os israelitas tinham saído do Egito.
39 Naw Aaron na one hundred and twenty-three years wen e die for Mount Hor.
39 Arão tinha cento e vinte e três anos de idade quando morreu.
40 Arad and Kanaan pipol kings wey dey stay for di sout-side for di land wey dey Kanaan kon hear sey Israel pipol dey kom.
40 Então o rei cananeu de Arade, que morava na região sul da terra de Canaã, soube que os israelitas estavam chegando.
41 Dem travel from Mount Hor go Zalmonah.
41 — ausente —
42 From Zalmonah, dem travel go Punon
42 — ausente —
43 and from Punon, dem kon go Obot.
43 — ausente —
44 Dem travel from Obot go Iye-Abiram, wey dey near Moab.
44 — ausente —
45 Dem travel from Lim go Dibon
45 — ausente —
46 kon from der travel go Almon-Diblataim.
46 — ausente —
47 Dem travel from Almon-Diblataim go Abarim Mountin before Nebo.
47 — ausente —
48 Dem from Abarim Mountin go Moab plain land near Jordan River for where dem dey cross go Jeriko.
48 — ausente —
49 Dem kon stay for Jordan River, from Bet-Jeshimot go rish Abel-Shittim for Moab.
49 — ausente —
50 God tell Moses for Moab near Jordan River wey dey di oda side for Jeriko:
50 Nas planícies de Moabe, junto ao rio Jordão, na altura de Jericó, que ficava no outro lado do rio, o Senhor mandou que Moisés desse
51 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen una don cross komot from Jordan River go Kanaan land,
51 aos israelitas as seguintes ordens: — Quando vocês atravessarem o rio Jordão e entrarem na terra de Canaã,
52 una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.
52 expulsem todos os moradores daquela terra. Destruam todos os seus ídolos de metal e de pedra e todos os seus lugares de adoração.
53 Una must drive all di pipol wey dey stay der komot kon stay for di land, bikos I don gi-am to una.
53 Tomem posse da terra e morem nela porque eu a estou dando a vocês.
54 Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.
54 Repartam a terra, por sorteio , entre as tribos e os grupos de famílias. Aos grupos de famílias mais numerosos deem uma parte maior; e aos grupos menos numerosos deem uma parte menor.
55 But if una nor drive di pipol komot, den dem go dey give una problem and dem go trobol una for di land.
55 Porém, se vocês não expulsarem os moradores do país, os que ficarem serão para vocês como espinhos nos seus olhos e como ferrões nas suas costas e trarão problemas para vocês na terra em que vocês morarem.
56 If una nor drive dem komot, I go distroy una, just as I plan to distroy dem.’ ”
56 E farei com vocês tudo o que eu havia pensado fazer com eles.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?