Salmos 81

PCM

1 Make wi sing praiz God wey bi awa strent.

2 Make una sing and play sheke-sheke.

3 Make una blow ram horn

4 Bikos dis na wetin dem rite for Israel law

5 E make dis law for Israel pipol wen E attack Egypt land just to free us.

6 “Si, I don take di load komot from una shoulder;

7 Una kry to mi for help wen una dey trobol and I save una;

8 My pipol make una listin to mi as I dey warn una!

9 Una must nor serve anoda god;

10 Bikos na mi wey bi una Oga God, save una from Egypt land.

11 But my pipol nor gri listin.

12 So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do

13 How I wish my pipol go gri listin to mi!

14 Den I for fit kwik distroy dia enemies!

15 Make pipol wey hate God, fear as dem si am;

16 But I go give Israel pipol betta food chop;

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado