Salmos 106

PCM

1 Make wi praiz God! Make wi tank am, bikos E dey good!

2 Who fit kount all di wonderful mirakles wey God don do?

3 Joy dey for pipol wey dey do well

4 My God, wen Yu dey show yor favor to yor pipol,

5 Make I share for di joy wey Yu dey give

6 Wi don sin like awa grand-grand papa.

7 Awa grand-grand papa dem nor tank Yu for all wetin Yu do for dem for Egypt.

8 But God still save dem,

9 E kommand di Red Sea make e dry

10 and E save dem from dia enemies

11 Den, di river kover and kill dia enemies

12 So en pipol kon bilive en promise

13 But si as dem kwik forget wetin God do!

14 For di desert, dem bigin put eye for bad-bad tins

15 So God give dem wetin dem ask for,

16 Di pipol for di kamp

17 Bikos of dis, di eart open kon swallow Datan,

18 Fire fall on-top all doz wey dey follow dem

19 Den di pipol make one juju with gold for Mount Sinai

20 Dem shange dia God wey get glory

21 Dem forget God,

22 and plenty wonderful tins for Ham

23 So God kon sey E go distroy dem.

24 So some pipol nor enter di promise land,

25 Instead, dem dey komplain for dia kamp

26 So, God swear sey E go kill dem

27 kon skata dia shidren-shidren among di nashons

28 Den awa grand-grand papa join bigin woship Baal for Peor,

29 Dem make God vex with all dis tins,

30 But Finehas get strong mind kon stand for di pipol

31 And from dat time, dem kon si am as raitious man.

32 For Meribah, di pipol make God vex kon put Moses for trobol,

33 bikos dem make Moses vex

34 Israel pipol nor gri distroy all dia enemies wey dey di land,

35 Instead, dem bigin make friends with pipol wey nor know God

36 den dem bigin woship dia juju

37 and dem even sakrifice dia sons

38 Dem kill innocent pipol kon sakrifice dia sons and dotas give Kanaan juju,

39 Dem dirty diasef with di wiked tins wey dem don do

40 and na dis make God leave en pipol

41 E give dem to dia enemies and na pipol wey hate dem

42 Dia enemies opress dem

43 Even doh God save dem many-many times,

44 But God still sorry for dem wen dem dey trobol

45 E remember en kovenant with dem kon sorry for dem,

46 So dia enemies wey bi dia oga, God

47 Naw, my Oga God,

48 Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey dey alive forever and ever!

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado