1 Make wi tank God,
2 Make pipol wey God don save, tok about am.
3 Bikos E don gada en pipol from many land;
4 even doz wey dey waka for di wildaness
5 Dem bin dey hongry and wota nor dey to drink
6 so dem kry as dem dey trobol sey,
7 E take dem go where dem go for dey save;
8 So make dem praiz God,
9 Bikos E dey give wota to pipol wey nid am
10 Some sidan for where dark pass
11 bikos dem go against God word,
12 and na dis rizin make God ponish dem,
13 Wen dem dey trobol,
14 E komot dem from di darkness
15 So make dem praiz God,
16 bikos E break di prison gate wey dem make with bronze
17 Bikos some nor get sense,
18 Dem nor even fit chop
19 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey,
20 E send en words kon heal dem
21 So make dem praiz God,
22 Make dem tank am with sakrifice
23 Some use ship for sea dey travel
24 Dem si all di tins wey God dey do;
25 E kommand and breeze raiz-up
26 Di waves karry di ship up-and-down for di sea
27 So dem kon dey shake and stagga like pesin wey don drink
28 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey,
29 God stop di wave for di sea
30 Dis kon make doz wey dey drive di ship happy,
31 So make dem praiz God, bikos of en great love and di wonderful tins wey E do for dem.
32 Make dem praiz am for where pipol dey
33 bikos E turn river to desert and spring wota to land wey dry well-well.
34 E turn di land wey get fruit to land wey nor get anytin at-all,
35 But for en pipol,
36 den E bring doz wey dey hongry make dem
37 Dem plant seeds and vine for di land
38 E bless dem, so dat dem go born
39 But as for dia enemies,
40 God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.
41 Yet E save poor pipol from doz wey dey opress dem kon make dia family many like plenty animals.
42 Wen pipol wey dey obey God si all dis tins, dem go happy,
43 So anybody wey get sense, make e learn from all dis tins