1 Make wi tank Oga God!
2 Make wi sing to am.
3 Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God,
4 Make wi look for God and en pawa wey E dey give!
5 Make wi remember all di wonderful tins wey E do;
6 us wey bi en savants, Abraham shidren
7 Na-im bi di Oga awa God.
8 E always dey keep en kovenant;
9 Dis na di kovenant wey E make with Abraham
10 E give di promise to Jakob, just as E kommand and for Israel pipol,
11 “I go give una Kanaan land
12 E tok dis tin wen dem neva plenty and dat time,
13 Dem waka from kountry to kountry,
14 Yet, E nor let anybody opress dem.
15 “Make una nor tosh dis pipol wey I choose
16 E kause honga for Kanaan land wen E
17 Den E send Josef go Egypt for en pipol front
18 Di shain for Josef leg kon dey pain am
19 Until di time rish for Josef to do wetin e dream
20 Den Fero send for am kon free am.
21 and Fero make Josef oga for evritin wey dey en house;
22 E fit send doz wey dey serve di king as e wont
23 Den Israel kon go Egypt
24 So God kon make Israel pipol plenty
25 Den God turn Egypt pipol against Israel pipol and dem kon plan against God pipol.
26 But God send en savant Moses with Aaron wey E choose,
27 Dem do wonderful tins for Egypt pipol front
28 God kover Egypt with darkness,
29 E turn dia wota to blood
30 Den frog kon full di town
31 Wen God tok,
32 God allow strong block fall for Egypt instead of ordinary rain
33 E distroy dia grape vine
34 God tok and many-many lokust kon kom;
35 Dem chop evry green leaf for di land
36 Den God kill both di pipol and dia animals first-born for Egypt
37 God take en pipol komot from Egypt with many silva and gold
38 Egypt pipol happy wen Israel pipol dey komot from dia land,
39 God kover Israel pipol with kloud
40 Dem ask for meat and God give dem kwail bird;
41 E divide di rock and wota kom out
42 bikos E remember en promise
43 So E take en pipol komot Egypt with joy;
44 Doz wey nor know am, E give dia land to Israel en pipol
45 All dis tins happen make dem for dey follow God laws