1 My soul, make Yu praiz God!
2 Yor dress dey shine like lite
3 Yu build yor palis
4 Breeze na yor messenja
5 Yu build di world on-top strong foundashon,
6 Yu kover di eart with wota
7 Wen Yu kommand,
8 Mountins dey raiz-up
9 Na Yu set where di sea go flow rish,
10 Yu turn springs to rivers
11 Dem dey provide wota for all di animals wey dey di field;
12 Birds dey build house near di rivers
13 From God house for heaven,
14 Yu dey make grass grow for animals to chop
15 wine wey go make us happy;
16 God send rain give en tree make dem for dey grow well;
17 Di birds dey make dia house for der
18 Wiked goat dey stay di high mountin;
19 God make di moon to mark di mont and di sun dey shine just as God program am.
20 God dey bring darkness and nite kom and na dat time,
21 Even lions dey kry bikos of honga
22 but wen sun don dey kom out,
23 Den men go-go do dia work
24 So my God, make Yu si all di difren tins wey Yu don do!
25 Di sea dey der, both wide and small ones wey get difren tins wey Yu kreate
26 Di ship dey travel on-top sea
27 All wetin Yu kreate dey wait for Yu to give dem food wey dem go always dey chop.
28 Yu give dem food and dem kollect am;
29 Wen Yu nor ansa dem, dem go dey fear.
30 Na yor breath wey dey give life,
31 God glory go always dey forever!
32 E look di eart and di eart shake;
33 So I go sing to God as long as I dey;
34 Make wetin I dey tink, make belle sweet am
35 So, make sinnas vanish komot from di eart and make wiked pipol disappear!