Salmos 10

PCM

1 My God, wetin make Yu stand far from mi?

2 Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol.

3 Bikos dem dey make mout about di evil tins wey dem dey do.

4 Wiked pipol too sturbon and dem dey always tink sey,

5 Dem dey prosper for evritin wey dem dey do.

6 Dem dey tell demsef sey, “No bad tin go ever happen to us!

7 Na curse, lie and to treaten pipol, full dia mout.

8 Dem dey hide wait for di village gate;

9 Like lion wey hide for korna,

10 Dem dey kill pipol wey nor get pesin wey go help dem;

11 Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us!

12 So my God, make Yu raiz-up kon ponish wiked pipol!

13 Why wiked pipol dey go free sef, even wen dem nor respet God?

14 But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause.

15 Make Yu break wiked and evil pipol hand!

16 Na God bi king forever and ever!

17 Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get.

18 Yu go judge well for shidren wey nor get papa and mama and doz wey dem dey opress,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado