1 If yu nid to choose between good name and plenty propaty, make yu choose good name,
2 Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi,
3 Wise pipol dey si trobol dey run,
4 If yu obey God kon honbol yorsef,
5 Trobol and wahala dey where wiked pipol dey waka pass,
6 Make yu tish yor pikin how e go take live en life and wen e don old,
7 Na rish pipol dey rule poor pipol
8 Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own
9 Do good and share yor food with poor pipol,
10 If una porshu proud pipol komot from where una dey,
11 Pesin wey get klean heart and always dey tok well,
12 God dey protet doz wey dey tok trut,
13 Lazy pipol dey always sey, “Lion dey outside and e go kill us”,
14 Pesin wife wey dey sleep with oda men,
15 Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good,
16 If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor
17 Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok
18 yu go happy, if yu remember
19 I go tell yu evritin naw,
20 I don rite thirty words wey go give yu wisdom,
21 tish yu wetin trut really mean.
22 Make yu nor trit poor pipol anyhow bikos yu get pawa!
23 bikos God go judge dia kase for dem
24 Make yu nor make friend with pipol
25 bikos if yu learn dia behaviour,
26 Make yu nor promise to pay money
27 bikos if yu nor fit pay,
28 Make yu nor remove di old boundary stone wey yor grand-grand papa
29 Yu don si pesin wey get good work?