Números 2
PCM vs ARC
1 God kon tell Moses and Aaron:
1 E falou o Senhor a Moisés e a Arão, dizendo:
2 “Evribody for Israel must stay with en family; dem must stay near di tent where dem for dey do meetin.”
2 Os filhos de Israel assentarão as suas tendas, cada um debaixo da sua bandeira, segundo as insígnias da casa de seus pais; ao redor, defronte da tenda da congregação, assentarão as suas tendas.
3 Naw, di pipol wey stay for east, where di sun for dey raiz, na Judah pipol, just as e suppose bi. Di pesin wey dey lead Judah pipol, na Nahshon, wey bi Amminadab pikin.
3 Os que assentarem as suas tendas da banda do oriente, para o nascente, serão os da bandeira do exército de Judá, segundo os seus esquadrões; e Naassom, filho de Aminadabe, será príncipe dos filhos de Judá.
4 Di pipol wey dem kount for dis group na 74,600.
4 E o seu exército e os que foram contados deles foram setenta e quatro mil e seiscentos.
5 Doz wey stay klose to dem na Issakar tribe. Di pesin wey dey lead Issakar pipol, na Netanel wey Zuar bi en papa.
5 E junto a ele assentará as suas tendas a tribo de Issacar; e Natanael, filho de Zuar, será príncipe dos filhos de Issacar.
6 Di pipol wey dem kount for dis group na 54,400.
6 E o seu exército e os que foram contados deles foram cinquenta e quatro mil e quatrocentos.
7 Di oda one na Zebulun tribe. Di pesin wey dey lead Zebulun pipol na Eliab wey bi Helon pikin.
7 Depois, a tribo de Zebulom; e Eliabe, filho de Helom, será príncipe dos filhos de Zebulom.
8 Di pipol wey dem kount for dis group na 57,400.
8 E o seu exército e os que foram contados deles foram cinquenta e sete mil e quatrocentos.
9 All di pipol wey dem kount for Judah wey stay akordin to dia group, na 186,400. Na dem go travel for front.
9 Todos os que foram contados no exército de Judá, cento e oitenta e seis mil e quatrocentos, segundo os seus esquadrões, estes marcharão primeiro.
10 For di sout, doz pipol wey dey under Reuben tribe, stay akordin to dia group and di pesin wey dey lead Reuben pipol, na Elizur wey en papa na Shedeur.
10 A bandeira do exército de Rúben, segundo os seus esquadrões, estará para a banda do sul; e Elizur, filho de Sedeur, será príncipe dos filhos de Rúben.
11 Di pipol wey dey under Reuben tribe na 46,500.
11 E o seu exército e os que foram contados deles foram quarenta e seis mil e quinhentos.
12 Di pipol wey go stay near dem, na Simeon tribe. Di pesin wey dey lead Simeon pipol na Shelumiel wey Zurishaddai born.
12 E junto a ele assentará as suas tendas a tribo de Simeão; e Selumiel, filho de Zurisadai, será príncipe dos filhos de Simeão.
13 Di pipol wey dey under Simeon tribe na 59,300.
13 E o seu exército e os que foram contados deles foram cinquenta e nove mil e trezentos.
14 Di next pipol na Gad tribe. Di pesin wey dey lead dem na Eliasaf wey bi Deuel pikin.
14 Depois, a tribo de Gade; e Eliasafe, filho de Deuel, será príncipe dos filhos de Gade.
15 Di pipol wey dey under Gad tribe na 45,650.
15 E o seu exército e os que foram contados deles foram quarenta e cinco mil e seiscentos e cinquenta.
16 All di pipol wey dey Reuben kamp akordin to dia group na 151,450. Na dem bi di sekond group to travel.
16 Todos os que foram contados no exército de Rúben foram cento e cinquenta e um mil e quatrocentos e cinquenta, segundo os seus esquadrões; e estes marcharão em segundo lugar.
17 Between di first group and di sekond group, na Levi pipol go waka for dia centre and dem go karry di tent. Dem go travel just as dem kamp, evry group akordin to en own place under en family name.
17 Então, partirá a tenda da congregação com o exército dos levitas no meio dos exércitos; como assentaram as suas tendas, assim marcharão, cada um no seu lugar, segundo as suas bandeiras.
18 Di group for west na Efraim tribe. Di pesin wey dey lead dem na Elishama wey Ammihud born.
18 A bandeira do exército de Efraim, segundo os seus esquadrões estará para a banda do ocidente; e Elisama, filho de Amiúde, será príncipe dos filhos de Efraim.
19 Di pipol wey dey under Efraim tribe na 40,500.
19 E o seu exército e os que foram contados deles foram quarenta mil e quinhentos.
20 Di pipol wey go stay near dem na Manasseh tribe. Di pesin wey dey lead dis group na Gamaliel wey Pedahzur bi en papa.
20 E junto a ele, a tribo de Manassés; e Gamaliel, filho de Pedazur, será príncipe dos filhos de Manassés.
21 Di pipol wey dey under Manasseh tribe na 32,200.
21 E o seu exército e os que foram contados deles foram trinta e dois mil e duzentos.
22 Di pipol wey go stay near dem na Benjamin tribe. Di pesin wey dey lead dis group na Abidan wey Gideoni born.
22 Depois, a tribo de Benjamim; e Abidã, filho de Gideoni, será príncipe dos filhos de Benjamim.
23 Di pipol wey dey under Benjamin tribe na 35,400.
23 E o seu exército e os que foram contados deles foram trinta e cinco mil e quatrocentos.
24 All di pipol wey dey Efraim tribe akordin to dia group, na 108,100. Na dem go bi di third group to travel.
24 Todos os que foram contados no exército de Efraim foram cento e oito mil e cem, segundo os seus esquadrões; e estes marcharão em terceiro lugar.
25 Di group for nort na Dan tribe. Di pesin wey dey lead di group na Ahiezer wey Ammishaddai born.
25 A bandeira do exército de Dã estará para o norte, segundo os seus esquadrões; e Aiezer, filho de Amisadai, será príncipe dos filhos de Dã.
26 Di pipol wey dey under Dan tribe na 62,700.
26 E o seu exército e os que foram contados deles foram sessenta e dois mil e setecentos.
27 Di pipol wey go stay near dem na Asher tribe. Di pesin wey dey lead di group na Pagiel wey bi Okran pikin.
27 E junto a ele assentará as suas tendas a tribo de Aser; e Pagiel, filho de Ocrã, será príncipe dos filhos de Aser.
28 Di pipol wey dey under Asher tribe na 41,500.
28 E o seu exército e os que foram contados deles foram quarenta e um mil e quinhentos.
29 Di pipol wey go stay near dem na Naftali tribe. Di pesin wey dey lead di group na Enan pikin, Ahira.
29 Depois, a tribo de Naftali; e Aira, filho de Enã, será príncipe dos filhos de Naftali.
30 Di pipol wey dey under Naftali tribe na 53,400.
30 E o seu exército e os que foram contados deles foram cinquenta e três mil e quatrocentos.
31 All di pipol wey dey Dan kamp, na 157,600. Na dem go travel last, just as dem arrange am.
31 Todos os que foram contados no exército de Dã foram cento e cinquenta e sete mil e seiscentos; estes marcharão no último lugar; segundo as suas bandeiras.
32 Israel pipol wey dem kount akordin to dia group na 603,550.
32 Estes são os que foram contados dos filhos de Israel, segundo a casa de seus pais; todos os que foram contados dos exércitos pelos seus esquadrões foram seiscentos e três mil e quinhentos e cinquenta.
33 But dem nor kount Levi pipol join, bikos God don kommand Moses sey na so e go bi.
33 Mas os levitas não foram contados entre os filhos de Israel, como o Senhor ordenara a Moisés.
34 So Israel pipol do all wetin God tell Moses; na so dem kamp under dia family name kon travel; each pesin with en tribe and family.
34 E os filhos de Israel fizeram conforme tudo o que o Senhor ordenara a Moisés; assim, assentaram o arraial segundo as suas bandeiras; e assim marcharam, cada qual segundo as suas gerações, segundo a casa de seus pais.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?