1 Make una sing new song for God, bikos E don do wonderful tins!
2 God show en pawa to diliver
3 E don remember en promise to love and kare for Israel pipol
4 So make all di eart shaut to God;
5 Make dem sing dia praiz give God with harp,
6 trumpets and di sound from ram horn.
7 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God!
8 Make di rivers klap dia hand
9 before awa Oga God,