1 Make una sing new song for God!
2 Make una sing and praiz God name.
3 Make una rite di wonderful tins wey E do among di nashons.
4 God dey great! Make all praiz bi en own!
5 Oda nashons god, na just juju dem bi,
6 Honor and majesty dey round am;
7 Make all di nashons for di world know God well;
8 Make una give God di glory wey bi en own!
9 Make una woship God with all en glory and wonders.
10 Make una tell di nashons sey, “Na God dey reign!”
11 Make di heavens and di eart dey happy!
12 Make di field and di plants, shaut for joy!
13 before God, bikos E dey kom! Yes, E dey kom judge di eart.