1 My Oga wey dey fight for pipol.
2 Raiz-up make Yu judge di pipol for di world
3 My God, na wen Yu won take judge wiked pipol?
4 How long dem go dey tok anyhow?
5 Oga God, dem dey kill yor pipol
6 Dem dey kill wimen wey dia husband don die,
7 Dem sey, “God nor dey si us! Israel God
8 But una wey bi fool, make una tink again!
9 Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word?
10 If E fit ponish wiked nashons,
11 God know wetin pipol dey tink;
12 So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy.
13 Yu dey free dem from trobol
14 God nor go rijet en pipol;
15 God good judgement go kom again and doz wey get betta
16 Naw, who go protet mi from wiked pipol?
17 If to sey God nor kom help mi, I for don die and pipol for don forget mi.
18 But I shaut kon kry sey,
19 Wen I dey fear sey evritin don finish for mi, Yu kon konfort,
20 Wiked leaders go fit sey God dey dia side?
21 Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite
22 But na God bi di place where I hide put;
23 So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins.