1 E dey good to tank God.
2 For morning, e dey good
3 with harp wey get ten rope and jita.
4 My God, Yu dey make mi happy
5 Wi dey si di great work wey Yu do!
6 Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do
7 “Wiked pipol dey grow like grass and doz wey dey do evil dey prosper,
8 But Yu, my Oga God,
9 Yor enemies go die trowey and all di pipol wey dey do evil,
10 But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass,
11 My eyes don si my enemies dey fall
12 But doz wey dey fear God, go prosper like bambo tree
13 Bikos God don plant dem for en house,
14 Dem go still dey produce fruit for old age!
15 Dem go sey, “God dey judge well!