1 My Oga God, from generashon to generashon
2 Yu bi God wey nor dey die!
3 Yu make human being go back to san where Yu from kreate dem wen Yu sey,
4 To Yu, one tazon years bi like one day
5 Yu dey swip pipol trowey like dream wey dey vanish.
6 For morning, dem dey grow and shine,
7 Yes, yor vexnashon dey kill us
8 Yu know all di sins wey wi kommit;
9 Yes! As wi dey alive,
10 Na seventy years Yu give us!
11 So na who go fit know as Yu dey vex rish?
12 So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being,
13 My God, make Yu kom back to us!
14 Make Yu satisfy us evry morning with yor love wey nor dey fail,
15 Make Yu replace awa former sofa with happiness
16 Make Yu let wi yor savants si yor works again
17 Make di Oga awa God show us en favor,