Salmos 89

PCM

1 I go always dey sing about God love wey nor dey fail!

2 Yor love wey nor dey fail go last forever.

3 God sey, “I don make kovenant with David, my savant wey I choose.

4 ‘I go make en shidren-shidren king forever;

5 So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do

6 My God, na who pipol won take kompare Yu for all di heavens?

7 Even angels dey honor am wen dem gada togeda

8 My Oga God wey dey rule evriwhere!

9 Na Yu dey rule di sea

10 Yu distroy and kill Rahab

11 Na Yu get di heavens and di eart;

12 Na Yu kreate di nort and sout.

13 Pawa dey yor hand; yor hand strong well-well!

14 Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne.

15 Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy;

16 Dem dey happy evriday

17 Na Yu bi dia strent and glory and e dey sweet Yu to make us strong

18 Yes! Awa proteshon dey kom from God

19 Before-before, Yu tok thru vishon to pipol wey dey obey Yu.

20 I don si my savant David

21 I go support am with my hand and with my hand wey get pawa,

22 En enemies nor go fit win am and wiked pipol pawa

23 I go distroy pipol wey dey tok against am

24 My goodness and love wey nor dey fail,

25 I go make am rule many kingdoms

26 Den e go koll mi kon sey,

27 I go make am my first-born and bikos I choose am as king,

28 I go love and dey kind to am forever and my kovenant with am,

29 I go gi-am one son wey go take-ova from am and just as di days for heaven nor dey end, na so too en kingdom nor go ever end.

30 But if en shidren-shidren nor gri listin to my kommand

31 if dem nor gri follow my ways

32 I go ponish dem with rod kon flog dem with kane,

33 But I nor go stop to love am

34 No! I nor go break my promise;

35 Yes! I don promise David and bikos I dey holy,

36 en shidren-shidren go bi king forever

37 E go dey forever like di moon

38 But naw, God, Yu don rijet and porshu David shidren-shidren.

39 Yu don forget di kovenant wey Yu make with am

40 Yu don break di wall wey dey guide am

41 Anybody wey dey pass,

42 Yu don give en enemies pawa

43 Yu make sure sey en swod nor mean anytin

44 Yu don end en glory

45 Yu don make am old before en time

46 So, my God, na how long dis tins go happen?

47 Make Yu remember how my life short rish

48 Evribody go die, bikos nobody fit stay forever

49 So my God, where all di good tins wey Yu bin do for us;

50 Make Yu konsida how dem dey disgrace yor savant

51 Yor enemies dey laf and fool mi.

52 But with all dis tins wey dey happen,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado