1 My God, make Yu hear my prayer;
2 Make Yu protet and save mi,
3 Make Yu sorry for mi, my Oga God,
4 My God, make Yu make mi happy,
5 Yu dey good and ready to forgive awa sins
6 So my God, make Yu listin well-well to my prayers;
7 I go koll Yu wen ever I dey trobol and Yu go ansa mi.
8 My God, no oda god bi like Yu.
9 Oga God, all di nashons wey Yu make,
10 bikos Yu big well-well
11 so make Yu tish mi yor ways, so dat I go live my life as Yu wont am!
12 My Oga and God, I go praiz Yu with all my heart,
13 bikos di love wey Yu get for mi,
14 My God, wiked pipol dey raiz against mi; sturbon pipol dey won kill mi.
15 But Yu, my Oga, Yu bi God wey dey sorry and pity for pipol;
16 Make Yu turn face mi kon sorry for mi!
17 Make Yu show mi sign sey Yu go favor mi.