1 My Oga God wey dey rule ova evritin,
2 I really love to dey di kourt wey dey God temple.
3 Even birds get house for der and sparo bird still build dia nest
4 Pipol wey dey stay and always praiz God for en temple,
5 Pipol wey get pawa thru Yu, si as dia blessing big rish too.
6 As dem dey pass thru Baka Valley, Yu dey provide wota for dem,
7 Yu dey provide for dem as dem dey travel go di temple
8 My Oga! Di God wey get pawa!
9 My God, make Yu favor di king wey dey guide us!
10 Only one day for yor house betta pass one tazon years for anoda place!
11 Oga God na awa sun and naim dey protet us.
12 My Oga wey bi God for Heaven Sojas,