1 My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own.
2 Dem don kill yor savants kon leave dia body for groun make bird chop dem.
3 Blood dey flow like wota for evriwhere for Jerusalem
4 Awa neighbours dey laf us; pipol wey dey around us,
5 My God, na how long Yu go dey vex with us?
6 Make Yu pour yor vexnashon for di nashons wey nor dey respet Yu;
7 bikos dem don finish yor pipol Israel
8 Make Yu nor kount awa grand-grand papa dem sin against us
9 My God wey dey save us, make Yu kom help us!
10 Wetin make Yu allow wiked pipol even get mout to ask sey,
11 Make Yu listin to di prisonas kry.
12 My God, make Yu pay awa neighbours seven times for di mout
13 Den, wi yor pipol, di sheep for yor field, go tank Yu forever