Salmos 78

PCM

1 My pipol, make una listin to wetin I dey tok.

2 bikos na parabol I go take tok to una.

3 story wey awa grand-grand papa

4 Wi nor go hide dis trut from awa shidren;

5 E give law to Jakob shidren kon tell en pipol Israel,

6 so dat di next generashon go know;

7 So evry generashon go get hope and trust God

8 Dem nor go bi like dia grand-grand papa wey sturbon;

9 Efraim sojas, even doh dem get bow and arrow,

10 bikos dem nor gri keep God kovenant

11 Dem forget wetin E don do,

12 di mirakles wey E do for dia grand-grand papa

13 For der, E divide di sea

14 E dey lead dem with kloud for day

15 E tear rock open

16 E make wota kom out from di rock

17 Yet dem still dey sin against am;

18 Dem dey test God with sturbones for dia heart

19 Dem even tok against God ensef wen dem sey,

20 Yes! E fit nak rock make wota kom out,

21 Wen God hear dem, E vex well-well.

22 bikos dem nor gri bilive God

23 But E kommand di sky make e open,

24 E send manna kom down so dat en pipol go si food chop;

25 Dem chop food wey angels dey chop

26 God release di east wind for heaven

27 E send meat like dust go give dem

28 E make di birds dey fall

29 and di pipol chop beleful.

30 But before dem even beleful,

31 God kon dey vex for dem and E kill all dia strong-strong men.

32 But even as all dis tins dey happen, di pipol still dey sin.

33 So E kon make dem die with disgrace

34 Wen God dey kill dem, dem kon dey beg make E sorry for dem.

35 Den dem remember sey na God bi dia rock;

36 But dem dey lie give God

37 Dia heart nor dey loyal to God

38 Yet, God sorry for dem kon forgive dem dia sins and E nor distroy all of dem.

39 bikos E remember sey na ordinary human being dem bi.

40 Dem sin against am many times for di wildaness

41 Dem always dey test and shalenge God.

42 Dem nor remember en pawa

43 Dem nor remember all di mirakles wey E do for Egypt;

44 bikos E turn Egypt river to blood,

45 E send many fly kon attack dem

46 E allow katapiller chop dia plants

47 E distroy dia grape vine with big-big stones

48 E kill and distroy dia animals with big-big stone

49 E show dem en great vexnashon and anga.

50 E turn en vexnashon face dem.

51 E kill all di first sons for Egypt family;

52 But E lead en own pipol kom out like many sheep

53 E guide and keep dem as dem dey go;

54 E bring dem kom di borda for en holy land;

55 E porshu di nashons wey dey before dem

56 But Israel pipol still dey test and sin against di Most High God

57 Dem turn back and dem nor kon get faith like dia papa and mama.

58 Dem dey make God vex as dem dey build shrine for oda gods;

59 Wen God hear dem,

60 Den E leave en place for Shiloh,

61 E allow enemies karry en Kovenant Box

62 E give en pipol to enemies make dem kill dem with swod,

63 Na fire kill dia yong men

64 Dem kill dia priests and wimen wey dia husband don die,

65 Den God raiz-up like sey E just dey wake from sleep;

66 E skata en enemies kon disgrace dem forever.

67 But E rijet Josef shidren-shidren

68 Instead, E choose Judah tribe and Mount Zion wey E love.

69 E build temple wey high like heaven

70 E choose David en savant,

71 E take David from where e for dey kare for animals

72 E kare for dem with betta mind

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado