1 My God, I don run kom meet Yu make Yu protet mi;
2 Make Yu kom take and save mi, bikos Yu dey do wetin dey rite.
3 Make Yu bi my Savior and di Rock where I go always hide put.
4 My God, save mi from wiked pipol pawa
5 bikos na only Yu bi my hope and na from wen I bi small pikin,
6 Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi
7 My life na ezample to many pipol,
8 Dat na why I nor fit stop to praiz Yu
9 Naw, for my old age, make Yu nor rijet mi.
10 My enemies dey gossip mi.
11 Dem dey sey, “God don rijet am.
12 So, my God, make Yu nor leave mi,
13 Make Yu disgrace and distroy pipol wey dey akuiz mi.
14 But for mi, I go always dey wait for yor help
15 I go tell evribody about yor raitiousness and evriday,
16 My God wey get pawa,
17 My God, na from wen I bi small pikin,
18 Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi.
19 My God, yor good judgement dey rish di heavens
20 Even doh Yu don make mi sofa well-well,
21 I know sey Yu go karry mi put for where dem go for honor mi well,
22 Den I go praiz Yu with harp,
23 I go shaut for joy kon sing with praiz,
24 and till I die, I go always dey tell pipol about yor good works,