1 My God, make Yu save mi,
2 I dey sink enter mud;
3 I don taya to dey shaut for help;
4 Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin,
5 My God Yu know all di sins wey I kommit for sekret;
6 My God and king wey get pawa; nor let shame katch doz wey trust Yu!
7 I don sofa well-well, bikos of Yu.
8 My own brodas dey trit mi like strenja;
9 True-true, di love wey I get for yor house dey shark mi;
10 I dey kry and I nor gri chop food
11 I wear sak klot and dem dey laf mi.
12 Doz wey dey sidan for di town gate dey tok about mi and pipol wey don drink,
13 So my God, make Yu hear my prayers kon favor mi
14 Make Yu save mi from di mud! Nor let mi sink!
15 Abeg! Make Yu nor let di wota karry mi go!
16 My God, make Yu ansa mi,
17 Nor leave yor savant, bikos I dey trobol,
18 Make Yu kom near and save mi!
19 Yu know how dem dey curse, disgrace and do mi anyhow
20 Dia curse dey pain and e dey make my heart kut;
21 Dem dey put poizin for my food
22 So, make dia food tabol bi trap for dem!
23 Make dia eyes blind
24 Make Yu pour yor judgement for dia head
25 Make dia house turn where pipol go dey trow dirty put
26 bikos dem don curse di pesin wey bi yor own.
27 So, make Yu hold dem,
28 Make Yu remove dia names from yor book wey get life!
29 Dem dey opress and sofa mi! So my God,
30 I go sing and praiz God name!
31 Dat one go sweet God pass ordinary melu
32 So make pipol wey dem dey opress, happy,
33 God dey listin to doz wey nor get help
34 So make di heavens and eart praiz am,
35 Bikos God go diliver Zion kon ribuild Judah town
36 En savant shidren-shidren go inherit am