1 Make God raiz-up!
2 As breeze dey blow smoke,
3 But pipol wey dey fear God go dey happy;
4 So, make una sing to God!
5 Na en bi papa to di pipol wey nor get papa
6 God dey find place put pipol wey don run komot from dia house bikos of war,
7 So, my God, wen Yu lead yor pipol go war;
8 di eart dey shake.
9 My God, na Yu make rain dey fall for yor pipol land.
10 bikos Yu dey stay with dem.
11 God tok di word;
12 “Kings and dia sojas dey run!”
13 Even pipol wey dey stay for animal house,
14 Wen God wey get pawa skata kings,
15 Mount Bashan high well-well;
16 Yu mountin wey get many top, why yu dey jealous di mountin wey God won stay?
17 Wen Oga God appear to en pipol for Mount Sinai,
18 God klimb go where high well-well.
19 Na Oga God get all di praiz, bikos na evriday E dey karry awa wahala.
20 Awa Oga na God wey dey diliver;
21 True-true, God dey nak en enemies head;
22 God sey, “I go koll dem back from Bashan,
23 so dat una go waka on-top dia blood
24 My God, dem dey si as Yu take dey waka;
25 Pipol wey dey sing, dey waka for en front;
26 So, God pipol wey gada togeda,
27 Benjamin tribe wey small pass, na dem dey front,
28 But God don kommand sey una go get pawa well-well.
29 as Yu kom out from yor temple for Jerusalem,
30 Make Yu ponish dat wiked animal wey dey wota
31 Egypt and Ethiopia pipol go dey ready to kom serve God on dia own;
32 So, make all di kingdom for di world
33 bikos na en bi di Pesin
34 Make una tok about di pawa wey God get;
35 God dey pawaful as E dey kom from en temple.