1 My God wey dey Zion, na betta praiz dey wait Yu,
2 Bikos Yu hear and ansa awa prayers;
3 Awa sins too many, so Yu don forget us,
4 But blessing go follow di pesin
5 Yu really ansa awa prayers
6 Yu kreate di mountins with yor strent
7 Yu make di rof sea kwayet
8 Even pipol wey dey far from awa land,
9 Yu visit di eart kon make rain fall put,
10 Yu dey wet di dry groun with rain,
11 Yu crown di year with yor good blessing and even where hard pass,
12 Di grass for wildaness dey fresh
13 Na animals full di fields and na betta food full di valley.