1 My Oga God, make Yu listin as I dey pray to Yu!
2 My King and my God,
3 Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning,
4 My God, Yu nor dey like bad tins;
5 So, proud pipol nor go fit stand for yor present,
6 Yu go distroy doz wey dey lie well-well.
7 Bikos of yor love wey nor dey die,
8 My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi,
9 bikos my enemies nor dey tok di trut.
10 My God, make Yu disgrace dem.
11 But make doz wey Yu dey guide, always dey happy!
12 My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu.