1 Na God bi di strong place wey wi dey hide put
2 Bikos of dis, wi nor dey fear wen di eart dey shake
3 River dey make betta nois
4 Di wota from di river dey bring joy kom God town;
5 Bikos God dey stay di town, e nor go skata.
6 Nashons don skata and dia kingdoms dey fall!
7 God wey dey lead heaven sojas dey with us
8 So make una kom si all di wonderful tins wey God don do.
9 E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear,
10 God sey, “Make una stand for where una dey,
11 God wey dey lead heaven sojas dey with us