1 Evribody! Make una kom!
2 Bikos di Most High dey good!
3 E distroy di pipol wey dey before us
4 E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life;
5 God dey waka go en throne
6 So, make una sing praiz God; make una praiz am;
7 Na God bi di King for all di eart.
8 Na God dey rule all di nashons,
9 Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol,