Salmos 45

PCM

1 Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am,

2 Na yu fine pass among evry oda man!

3 My strong warrior!

4 Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good.

5 Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart

6 My God, yor throne go dey forever and ever.

7 Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins.

8 Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot.

9 Kings dota dey join doz wey kom visit yu

10 All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart.

11 Bikos una prince dey happy for una beauti.

12 Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts.

13 Di king dota dey always dey happy for en room afta e don wear en fine-fine klot

14 Den dem go take am go meet di king

15 and dem go happy dey celebrate

16 Dia sons go bi king afta dia papa

17 I go make evry generashon honor and remember yor name

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado