1 Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol!
2 Make God protet and keep dem alive.
3 God dey kare for dem wen dem dey sick
4 My God, I dey pray sey, “Make Yu sorry for mi.
5 Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi.
6 Dem dey visit mi like sey dem bi my friends,
7 Pipol wey hate mi dey tok for each oda ear about mi
8 Dem sey, “E get some bad-bad diziz.
9 Even my best friend, di one wey I trust with evritin;
10 So Oga God, make Yu sorry for mi.
11 Like dis, I know sey I dey make belle sweet Yu,
12 Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent;
13 So make una praiz di Oga wey bi Israel God,