1 I wait with patient make God kon help mi,
2 E take mi komot from di pit where shame,
3 E don give mi new song to sing
4 Make una si as pipol wey trust God dey happy;
5 My Oga God, Yu don do wonderful tins for us.
6 Yu really don make mi undastand sey,
7 Den I sey, “Look, I don kom,
8 ‘My God, I won do wetin Yu wont,
9 I don tell yor pipol about how Yu dey judge.
10 All di good tins wey Yu do,
11 So Oga God, make Yu nor stop to dey sorry for mi.
12 Trobol gada round mi and I nor fit kount dem!
13 So my God, abeg, make Yu save mi!
14 Make shame and disgrace follow di pipol wey dey try to distroy mi.
15 Make shame and disgrace follow dem, bikos dem sey,
16 But pipol wey dey find Yu,
17 I dey poor and I nor get anytin,