Salmos 39

PCM

1 I tell mysef sey, “I go dey kareful for wetin I dey do and I nor go sin with wetin I dey tok.

2 But even as I dey kwayet and nor tok wetin good or bad,

3 Di more I dey tink about am, di more e dey pain mi for my heart;

4 “My God, na how long I go dey dis life?

5 Si! Yu don make my life short well-well and my whole life bi like one sekond to Yu.

6 Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin.

7 So, my God, where I won put my hope?

8 Make Yu save mi from my sins.

9 I kwayet for yor present;

10 But abeg, make Yu nor flog mi again!

11 Wen Yu ponish us for awa sins,

12 My God, make Yu hear my prayers! Make Yu listin to my kry for help!

13 Make Yu take yor vexnashon from mi,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado