1 My God, make Yu nor porshu or ponish mi,
2 Yor arrow don shuk mi.
3 and bikos Yu dey vex,
4 I dey die inside my own sin
5 Bikos of my sins,
6 I nor fit stand strait again and wahala full my life.
7 I dey shame well-well
8 I don taya and my own don finish.
9 So, Oga God, I know sey Yu know wetin I wont.
10 My heart dey beat fast-fast;
11 Pipol wey I love and wey bi my friends,
12 Yet, my enemies still dey set trap to kill mi.
13 But I bi like who nor dey hear wetin dem dey tok.
14 Naw, I bi like deaf to dem.
15 But I dey wait for Yu, my God.
16 I dey pray, “Make Yu nor let my enemies happy, bikos I fall for groun.”
17 Na die I dey so o-o, bikos na so-so pain I dey face.
18 But naw, I dey konfess my sins; I really dey sorry for evritin wey I don do.
19 I get many wiked enemies and dem hate mi without any rizin.
20 Dem dey pay mi bad for good kon dey oppoz mi for di good tins wey I do.
21 So my God, make Yu nor leave mi.
22 My God and Savior, make Yu kwik-kwik kom help mi.