Salmos 37

PCM

1 Make yu nor worry yorsef about wiked pipol

2 Bikos dem go soon die like grass.

3 Make yu trust God and do wetin dey good,

4 Make yu depend on God

5 Make yu kommit evritin wey yu dey do for God hand.

6 E go show sey yu dey innocent

7 So, make yu wait for God with patient!

8 Make yu nor dey vex, bikos na trobol,

9 God go distroy wiked pipol,

10 Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem,

11 Doz wey dey honbol,

12 Wiked pipol dey plan against God pipol;

13 But God just dey laf,

14 Wiked pipol dey use dia swod and bow take kill poor pipol,

15 But dia swod go stab dia own heart

16 So e dey good to fear God with di small money wey pesin get,

17 God go take wiked pipol pawa,

18 God dey guide innocent pipol evriday

19 E nor go leave dem wen tins hard and even wen honga dey,

20 But wiked pipol go die,

21 Wen wiked pipol borrow sometin, dem nor dey pay back,

22 Na doz wey God bless go get di land,

23 God dey lead doz wey dey fear am.

24 Even doh dem dey shake, dem nor go ever fall,

25 Bikos since wen I dey yong kon rish naw wey I don old,

26 Dis pipol dey always happy to give

27 So, make yu turn from bad tins kon do good

28 Bikos God like to dey judge well

29 Doz wey dey fear God go inherit di land

30 Doz wey dey fear God dey advise pipol well

31 Dem don make God law dia own,

32 Wiked pipol dey set trap for God pipol,

33 But God nor go let wiked pipol win

34 So make yu put yor hope for Oga God.

35 Pipol wey wiked and nor dey sorry for odas, I don si

36 but wen I look again,

37 So, make yu follow doz wey dey honest and dey do good,

38 God go distroy wiked pipol

39 But God go save doz wey dey fear am

40 God go help and save dem from wiked pipol.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado