1 Wiked pipol nor get good heart
2 Bikos dem blind,
3 Evritin wey dem tok na lie and dem dey deceive pipol.
4 Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan.
5 My God, yor love wey nor dey fail, big and wide like di heavens;
6 Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom.
7 My God, si as I value yor love wey nor dey fail!
8 Yu dey feed dem from di plenty food wey Yu get for yor own house
9 bikos na Yu bi di wota wey dey give life;
10 Make Yu pour yor love wey nor dey fail on pipol wey love Yu;
11 Nor let proud pipol opress mi
12 Si! Wiked pipol don fall!