1 My God, make Yu oppoz doz wey dey oppoz mi
2 Make Yu wear yor war klot,
3 Make Yu lift yor spear and javelin against pipol wey dey porshu mi,
4 Make shame and disgrace follow pipol wey dey try to kill mi;
5 Make Yu blow dem trowey like leaf wey breeze blow
6 Make Yu make dia way dark and make groun draw dem fall,
7 bikos I nor do dem any bad tin,
8 So make wahala kom meet dem at wons!
9 Den I go happy, bikos of my God.
10 I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey:
11 Wiked pipol dey lie for my head.
12 Dem dey pay mi bad for di good wey I do
13 Wen dem dey sick, I dey sorry for dem.
14 I dey mourn for dem, just as I go do for my broda or friend.
15 But wen I fall, dem go dey happy
16 Dem dey laf and koll mi difren names;
17 My God, na so Yu go just dey look dem?
18 Den I go tank Yu for where yor pipol gada put.
19 Make Yu nor let my enemies happy
20 Dem nor dey tok about peace.
21 Dem go dey shaut, “Yes o-o! Yes o-o!
22 My God, Yu know all dis tins.
23 Make Yu raiz-up kom defend mi!
24 Show sey I nor do anytin,
25 Make Yu nor let dem sey, “Si, wi don get wetin wi wont!
26 Make disgrace and shame follow pipol
27 But make Yu give joy and happiness to pipol wey dey help mi.
28 Den I go tok about yor korrect judgement