Salmos 34

PCM

1 I go always dey praiz God.

2 Na only God name I go take boast;

3 Kom make wi tok about how God great rish;

4 I pray to God and E ansa mi

5 Doz wey dey go meet am make E help dem,

6 I pray to God as I dey sofa and E ansa mi;

7 Bikos na God angel dey guide mi,

8 Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good:

9 Una wey bi God pipol, make una fear am,

10 Yong lions wey strong well-well still dey hongry,

11 My shidren, make una kom listin to mi

12 E get anybody wey won live betta life?

13 Den make yu nor use yor mout take tok bad tin

14 Make yu turn from wiked tins kon do wetin dey good.

15 Pipol wey dey do wetin dey rite,

16 But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins;

17 God dey hear en pipol wen dem koll am for help.

18 Pipol wey nor get hope, God dey-dey near dem;

19 Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well,

20 God dey protet en pipol well-well

21 but wiked pipol go must face wahala

22 God go save pipol wey dey serve am

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado