1 Una wey dey fear God, make una sing with joy;
2 Make una praiz God with di sweet sound from jita;
3 Make una sing new song take praiz am;
4 Bikos God word na true
5 E love anytin wey dey rite and good;
6 Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens.
7 E gada di sea for one place
8 So, make di whole world fear God and make evribody
9 Bikos na afta E tok, di world start!
10 God skata di nashons plan
11 But God plan go stand forever;
12 Si as blessing full di nashon wey God bi dia God,
13 God dey look from heaven.
14 Evritin wey dey alive for dis eart,
15 Na-im make dia heart,
16 Just as di plenty sojas wey king get nor go fit save am,
17 So make yu nor feel sey na yor shariot go make yu win,
18 But God dey guide doz wey dey fear am;
19 E save dem from deat
20 Na God bi awa hope.
21 Awa heart dey always happy,
22 My God, make yor love wey nor dey fail,