Salmos 18

PCM

1 My God, I love Yu well-well

2 Na God bi di rock wey dey protet mi.

3 I koll God wey get all di praiz

4 Deat dey round mi

5 na so-so grave I dey dream about and na to die,

6 But inside my trobol, I kry to God.

7 Fear kon make di pipol for di eart dey shake.

8 Smoke dey kom out from dia nose;

9 So, God open di heavens

10 E sidan on-top angel feada kon fly go;

11 E kon hide ensef for darkness

12 Betta tick kloud kover di lite wey dey round am

13 God vois from heaven bi like tonda

14 E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash,

15 Den as God kommand and as E just breath,

16 E kom down from heaven kon save mi,

17 E save mi from my enemies wey get pawa well-well;

18 Dem attack mi wen I dey trobol,

19 E take mi go where dey save;

20 God reward mi, bikos I do wetin dey rite;

21 bikos I dey always keep en kommand.

22 I dey follow all en rules

23 For God present, I nor do any bad tin; I don keep mysef from sin.

24 God reward mi, bikos I do wetin dey rite.

25 E dey show ensef sey E dey faithful to doz wey dey faithful

26 To pipol wey get pure heart,

27 Yu save gentol pipol,

28 Yu lite one lamp for mi.

29 With yor pawa, I fit kill many sojas.

30 God ways dey pafet and all en promise na true.

31 Na who bi God escept God?

32 God make mi strong with en strent

33 E make my leg strong for groun like deer own

34 E train my hand, so dat I go fit fight war

35 My God, Yu don give mi wetin go protet mi.

36 Yu don make betta road for mi,

37 I porshu my enemies kon katch dem

38 I kill all of dem finish

39 Yu don give mi strent to fight war;

40 Yu put my leg for dia neck

41 Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom.

42 I grind dem till dem turn to dust

43 Yu make mi win doz wey dey akuiz mi.

44 Wons dem hear about mi, dem dey obey.

45 Dem nor get strent again

46 God dey alive!

47 Na en bi di God wey dey ponish doz wey wound mi.

48 kon save mi from my enemies.

49 Bikos of dis, I go praiz God among di nashons;

50 Yu don give betta viktory to yor king;

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado