1 Make wi praiz God!
2 Make all en angels praiz am!
3 Make di sun and di moon, praiz am!
4 Make di sky, praiz am!
5 Make evritin wey God kreate, praiz am,
6 E put dem for where dem dey forever and ever.
7 Make all di tins wey dey inside di sea
8 Make big-big stones with fire,
9 Mountins and all di hills;
10 wild animals and ordinary animal; animals
11 kings for di eart and all di pipol;
12 yong men and yong wimen; old men and shidren,
13 Make all of dem praiz God name.
14 E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am