1 Make wi praiz di Oga wey bi awa God
2 Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una.
3 Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,
4 bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef,
5 Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem!
6 As dem hold swod wey get two mout for dia hand,
7 so dat dem go fit revensh dia enemies
8 Dem tie dia enemies kings with shains
9 and dem dey judge dem just as dem rite am.