Salmos 145

PCM

1 I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.

2 I go praiz Yu evriday.

3 God dey great! Na only en wi suppose to dey praiz!

4 Make evribody tell dia shidren-shidren about God mighty pawa;

5 I go always dey tink of yor majesty,

6 I go always dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do

7 Evribody go tok di story about di wonderful tins wey Yu don do;

8 God get mesi and dey sorry for pipol!

9 God dey good to evribody.

10 So Oga God, all yor works go tank Yu and di pipol wey bilive Yu,

11 Dem go tok about di glory wey dey yor kingdom;

12 Dem go tok about di wonderful tins wey Yu don do

13 bikos yor kingdom go dey forever and ever.

14 God dey help pipol wey don fall

15 So my God, evritin dey look up to Yu

16 Wen Yu open yor hand,

17 God dey rite for evritin wey E dey do;

18 God dey klose to all di pipol

19 Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont;

20 God dey protet all di pipol wey love am,

21 So, I go praiz God

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado