1 My God, make Yu hear my prayers;
2 Make Yu nor judge mi yor savant,
3 My enemies don porshu mi.
4 I nor get hope again
5 I remember before-before as I dey tink about all yor great works
6 I lift my hands and pray to Yu.
7 So, my Oga God,
8 Evry morning, make I dey hear about yor love wey nor dey fail,
9 Oga God, make Yu save mi from my enemies;
10 Make Yu tish mi to do wetin Yu wont,
11 My God, make Yu save mi,
12 Use yor love wey nor dey fail, take silent all my enemies kon distroy dem,