1 My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom!
2 Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu
3 My God, make Yu help mi kontrol my mout
4 Nor let mi waka enter evil or follow pipol do bad tins.
5 Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love!
6 Wen dem trow dia leaders down from rock,
7 Just as pesin dey klear and dig groun,
8 But my Oga God wey get pawa, I dey look up to Yu.
9 Make Yu keep mi from di trap wey dem don set for mi;
10 Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap