1 My God, make Yu save mi from wiked pipol!
2 doz wey dey plan evil for dia heart
3 Dia tongue dey wound pipol like snake
4 My God, nor let mi fall enter wiked pipol hand.
5 Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net
6 So I tell Oga sey,
7 My God wey get pawa,
8 So make Yu nor let wiked pipol win mi,
9 Make Yu distroy my enemies with di evil
10 Make hot shako fall for dia head.
11 Make Yu nor allow pipol wey dey lie,
12 But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress
13 True-true, pipol wey dey do wetin dey rite,