1 My God, Yu shek my heart well-well
2 Yu know wen I sidan or wen I stand up.
3 Yu dey si mi wen I dey travel and wen I dey rest for house.
4 My God, Yu know wetin I won tok
5 Yu dey my front kon still dey follow mi for back
6 Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi;
7 I nor go fit hide from yor Spirit! I
8 If I run go heaven, Yu dey der;
9 If I sey make I fly as day dey break
10 yor hand go guide mi for der
11 Even if I sey,
12 e nor get how di darkness dark rish wey Yu nor go fit si mi,
13 True-true, na Yu make my mind and my heart;
14 I go tank Yu, bikos di tins wey Yu dey do,
15 my bones nor hide from Yu,
16 Yu dey si mi wen I dey my mama belle.
17 My God, si as e hard mi to tink about wetin Yu dey tink for mi,
18 If I try to kount dem, dem go many pass san-san.
19 My God, I wish sey Yu go just kill wiked pipol finish!
20 Dem nor gri do wetin Yu kommand;
21 So my God, si as I hate pipol wey hate
22 True-true, I really hate dem
23 Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink!
24 Show mi anytin wey make Yu dey vex for mi.