Salmos 119

PCM

1 Make una si as God dey bless pipol

2 Pipol wey dey follow en rules

3 Dem nor dey do bad tins

4 God sey make wi obey

5 If to sey I fit live my life

6 den I nor go shame,

7 As I dey learn evritin about yor raitiousness,

8 I go obey yor laws,

9 Di only way yong pesin go if live betta life,

10 I don try well-well to find Yu.

11 I don keep yor word for my heart,

12 My God, I go praiz Yu,

13 I dey shaut and tok about

14 Just as I dey happy to get propaty,

15 I go learn yor kommand

16 I go obey yor laws

17 Make Yu dey good to mi wey bi yor savant,

18 Make Yu open my eyes to si di wonderful tins

19 Na strenja I bi for dis world,

20 I always dey happy

21 Yu porshu sturbon pipol;

22 So make Yu nor let dem laf and curse mi,

23 Even doh important pipol sidan dey plan against mi,

24 bikos yor law dey sweet

25 I liedan dey roll for dust;

26 I tell Yu about my problems and Yu ansa mi.

27 Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean

28 Make Yu enkourage mi with yor word,

29 Make Yu nor let mi dey deceive mysef;

30 I don choose to follow Yu;

31 I hold yor laws well, so my God,

32 I go run follow yor kommands,

33 My God, make Yu tish mi yor laws

34 Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok

35 Make Yu let mi follow yor kommand,

36 Instead of to dey love money,

37 Make Yu help mi take my eyes

38 Make Yu tell mi again about yor promise

39 Di tins wey dey make mi fear,

40 I dey wait since to obey yor kommand,

41 My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail

42 Den I go fit ansa pipol wey dey won kill mi,

43 Make Yu nor take yor word komot from my mout,

44 Den I go always dey obey yor laws

45 I go dey save,

46 I go speak to kings about yor laws

47 Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand!

48 I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws.

49 Make Yu remember di promise wey Yu make give mi,

50 Yor promise dey revive

51 Na so-so laf wiked pipol dey laf mi,

52 My Oga God, I dey tink about yor laws wey dey since

53 I dey vex for wiked pipol,

54 Anywhere wey I dey,

55 My God, for nite,

56 Na to obey yor kommand bi evritin

57 Na Oga God dey guide and save mi!

58 I wont yor blessing with all my heart,

59 Wen I tink as my life bi naw, I kon choose to follow yor ways.

60 So, I go kwik-kwik dey do wetin Yu kommand.

61 Wiked pipol dey won drag mi enter sin,

62 I dey wake-up for nite dey tank Yu,

63 Na pipol wey dey fear Yu bi my friends;

64 My God, yor love wey nor dey fail, full di world;

65 My God, Yu don do many good tins

66 I bilive yor kommand and naw,

67 I bin dey sofa, bikos I waka live yor ways,

68 Yu dey good and na only good tins Yu dey do;

69 Wiked pipol lie full my ear,

70 Dia heart dey empty and stupid,

71 My pains dey good for mi,

72 Yor kommand dey good to mi

73 Na Yu make and kreate mi.

74 Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi,

75 My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard.

76 Naw, make yor love wey nor dey fail, konfort mi,

77 Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die,

78 Make Yu disgrace doz wiked pipol wey dey lie for my head;

79 Make Yu add mi join di pipol wey dey fear Yu;

80 As I dey keep yor kommand, make evritin wey I dey do,

81 I taya as I dey wait make Yu save mi,

82 My eye just dey look to si sey wetin Yu promise, dey happen.

83 I bi like leda bag wey skwiz, bikos e dey where smoke full,

84 So, na how long I go dey wait?

85 Doz wiked pipol wey hate yor laws

86 But all yor kommand dey good,

87 Even doh dem don nearly kill mi,

88 So make Yu save my life with yor love wey nor dey fail;

89 My God, yor word wey dey forever,

90 Yu dey good to all generashon and na as Yu kreate di eart,

91 Evritin dey as dem dey kon rish today,

92 If to sey yor laws nor keep mi with joy,

93 I nor go ever forget yor kommand,

94 I bi yor own, so make Yu save mi,

95 Even doh wiked pipol dey hide for road to kill mi,

96 Naw, I don know sey evritin get where dem fit do rish and evribody get where dem know rish,

97 My God, si as I love yor laws

98 Yor kommandment make mi get sense pass my enemies,

99 Yes, I get betta undastandin pass my tishas,

100 I even get sense pass my eldas,

101 I don decide sey I nor go do any bad tin,

102 I neva sin against yor laws,

103 Yor word sweet well-well for my mout;

104 Yor kommandment don make mi undastand life well

105 Yor word na lantan wey dey guide my leg and lite wey dey make mi si road.

106 I don first promise and I dey promise again sey; I go always dey obey all yor kommandment.

107 My God, I don sofa well-well; so make Yu save my life just as Yu promise.

108 My God make Yu asept di ofrin wey my praiz bring and tish mi yor kommandment.

109 Even doh my life nor balance at-all, I nor go stop to obey yor kommandment.

110 Even doh wiked pipol set dia trap for mi, I nor go turn from yor kommandment.

111 Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont

112 and I dey ready to keep wetin Yu tok till I die.

113 I hate pipol wey dey pritend sey dem dey loyal to evribody,

114 Na Yu bi my proteshon and guide

115 Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life;

116 My God, make Yu give mi life as Yu promise,

117 Make Yu keep mi and I go dey save;

118 Yu don rijet all di pipol wey nor dey follow yor ways and naw,

119 Yu swip wiked pipol komot dis world like dirty;

120 I dey shake bikos I dey fear Yu

121 I dey do wetin dey rite,

122 Abeg, make sure sey Yu bless mi

123 I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi;

124 I bi yor savant, so make Yu show mi yor love wey nor dey fail

125 I bi yor savant, so make Yu give mi sense,

126 E don rish time wey God go take akshon,

127 True-true, I love yor kommand pass gold

128 All yor kommands dey korrect

129 Yor laws dey wonderful.

130 Di tishing for yor word dey give lite,

131 I dey hongry for yor kommandment;

132 Make Yu kom show mi yor mesi,

133 Make yor words guide my step,

134 Make Yu save mi from wiked pipol wey dey opress mi;

135 Make Yu look mi with love kon tish mi yor laws.

136 I dey kry like river wey dey flow,

137 My God, na Yu bi my raitiousness

138 Yor rules dey pafet

139 E dey pain mi well-well wen my enemies

140 I don test yor promise well-well

141 Even doh I nor mean anytin at-all to pipol,

142 Yor judgement na forever

143 Even doh pressure and wahala dey make mi taya,

144 Yor laws always dey rite;

145 My God, make Yu ansa mi,

146 Make Yu save mi,

147 I dey wake-up before day break well

148 I nor dey sleep for nite,

149 So my God, make Yu hear my kry, bikos of yor love wey nor dey fail!

150 Pipol wey nor dey obey yor law dey kom attack mi;

151 But my Oga God, Yu dey near and all yor kommand na true

152 and I don know from small pikin sey,

153 Make Yu si di sofa wey I dey sofa kom save mi,

154 Make Yu kom fight

155 Nobody go save wiked pipol,

156 My God, si as yor mesi great rish;

157 Many pipol dey trobol and wahala mi,

158 Wen I si lie-lie pipol, e dey make mi sick,

159 My God, make Yu si how I love yor kommands.

160 All yor kommand na true

161 Pipol wey get pawa dey trobol mi wen I nor do dem anytin,

162 Like pesin wey si many propaty karry for war,

163 Pipol wey dey lie and go against yor word,

164 I go praiz Yu seven times for one day,

165 Pipol wey love wetin Yu tok,

166 My God, I dey wait since make Yu

167 I dey obey yor laws,

168 Yes, I dey obey yor kommandment and yor laws,

169 My God, make Yu listin to my kry;

170 Make Yu listin to my prayers

171 Make praiz dey always kom out from my mout,

172 Make my tongue sing about yor word,

173 Make Yu help mi,

174 My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi,

175 Make I dey dis life,

176 I dey waka go like sheep wey waka lost for bush,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado