1 Di OGA tell my Oga God,
2 God go make yor kingdom big and strong for Jerusalem
3 Wen yu go war,
4 God don promise and E nor go break di vow wen E make sey:
5 Di Oga God stand for yor rite hand to protet Yu and E go kill many kings,
6 E go ponish di nashons
7 But di king go drink from di wota wey dey flow pass for di road