Salmos 109

PCM

1 My God wey I dey praiz,

2 as wiked pipol dey trobol

3 Dem gada round mi kon dey lie

4 I love dem, but dem dey try to distroy mi.

5 Dem dey pay mi bad for good and even doh I love dem,

6 Dem sey, “Make una bring one wiked man wey go tok against am.

7 Wen en kase don rish to judge,

8 Make en years for life nor plenty

9 Make en shidren and wife

10 Make en shidren beg waka

11 Make pipol wey e dey owe, kollect all wetin e get

12 Make nobody pity for am;

13 Make all en shidren die,

14 Make God nor ever forget di sins wey en papa kommit;

15 Yes! Make God always dey remember en sins

16 Bikos e nor gri help oda pipol;

17 E love to curse odas.

18 To am, to dey curse pesin bi like klot wey dem dey wear for body

19 Naw, make en curse go back to am kon dey with am like klot for body;

20 But all di pipol wey dey akuiz and tok bad about mi,

21 My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi,

22 I poor well-well!

23 I dey fade komot dis life like shadow;

24 Bikos I dey fast since, my legs don weak

25 Pipol for evriwhere dey use mi make yeye;

26 My Oga God, make Yu help mi!

27 Make dem si sey, dis na wetin Yu do

28 Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi!

29 Make disgrace follow pipol wey dey akuiz mi;

30 But I go always dey tank God

31 bikos E dey protet pipol wey nor get,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado