1 Wisdom don build en house
2 E don kill animals to take do party,
3 E send en savant go announce
4 “Pipol wey nor know anytin, make una kom inside!”
5 “Make una kom chop my food
6 Make una komot from where fools dey and una go get life.
7 If yu korrect proud pipol, dem go curse yu!
8 So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu;
9 Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more.
10 If yu won get wisdom, yu go first fear God.
11 Wisdom go add more years to yor age.
12 Na yu go gain if yu get wisdom,
13 Foolishness bi like woman wey nor know anytin at-all,
14 Di woman go sidan for front of en house
15 kon dey koll pipol wey dey waka pass;
16 “Pipol wey nor get sense, make una kom inside!”
17 “Wota wey dem tif dey sweet well-well
18 Doz wey fall for en trap nor know sey,