1 Make una hear mi!
2 Dem dey on-top di hill near di road!
3 Dem dey near di gate dey koll pipol
4 “Wi dey beg and koll evribody
5 Una wey nor know anytin, make una get wisdom.
6 Make una listin to mi!
7 Wetin I dey tok so, na trut;
8 Evritin wey I tok na true;
9 My words dey klear and evribody wey get wisdom,
10 Instead of silva, make una take my words;
11 Na mi bi wisdom; I betta pass gold;
12 I bi wisdom and I get sense well-well;
13 If to sey una dey fear God,
14 Kommon sense and suksess na my own.
15 I dey help kings rule well
16 All di ruler for dis world dey rule with my help,
17 I love only doz wey love mi;
18 I get propaty, honor,
19 Anytin wey una get from mi,
20 I dey follow korrect judgement
21 and doz wey love mi,
22 From biginnin, na mi God first kreate,
23 God kreate mi before di world start.
24 Dem born mi before God make di sea
25 Dem born mi before God make di mountins,
26 I dey before God kreate di eart,
27 I dey der wen E put di sky for where e dey
28 I still dey wen E put di kloud for sky;
29 kon orda sey make di wota wey dey di sea nor full pass as E kommand am.
30 I dey near am like pesin wey dey design house before dem build am.
31 I dey dance for di world wey E kreate
32 So, make yong pipol listin to mi naw
33 Make una listin to wetin I dey tish una kon get sense.
34 Make blessing follow di pesin wey dey listin to mi.
35 Doz wey find mi, go get life
36 But doz wey nor find mi, dey wound demsef