1 Dis na di wise words wey Solomon tok:
2 Propaty wey yu use wayo take get nor go do yu any good,
3 God nor go let honga kill good pipol
4 Lazines go make yu poor,
5 Pesin wey get sense dey plok en fruit for di rite time;
6 Blessing dey follow good pipol,
7 Pipol go remember good pesin bikos of di good tins wey e do,
8 Pipol wey get sense dey happy well-well wen dem advise dem,
9 Pipol wey dey tok trut dey save and sikure,
10 Pesin wey dey hide di trut dey kause trobol,
11 Good pesin word dey give long life,
12 Na only trobol bad belle dey kause,
13 If pesin get sense, e dey show wen e dey tok,
14 Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get,
15 Money dey protet rish pipol,
16 Na life bi di reward to do good,
17 Pipol wey dey listin if dem korrect dem go get long life,
18 Anybody wey pritend sey e like pesin,
19 Too mush tok dey make pesin sin,
20 Di words wey betta pesin tok bi like pure silva,
21 Many pipol dey gain from word wey betta pesin tok,
22 Wen God bless pesin, e dey get enough
23 Foolish pipol dey enjoy di bad tins wey dem dey do,
24 Raitious pipol dey get wetin dem wont,
25 Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey,
26 Nor allow lazy pesin work for yu,
27 Obey God and yu go get long life;
28 Di hope wey good pipol get, dey give dem joy,
29 God dey protet pipol wey dey tok trut,
30 Raitious pipol go always dey save,
31 Raitious pipol dey tok with sense,
32 If yu obey God, yu go always know di rite words to tok.